Letra da Música Beast Of No Nation de Fela Kuti

Que bom que você chegou até aqui!
Veja abaixo a letra da música que separamos para você!

Música em MP3
Ah- Let’s get now into another, underground spiritual game
Just go to help me the answer, go to say, “Aiya-kata”- Oh ya

O’feshe-Lu
AIYA-KATA *(after each line)
O’feshe- g’Ba

O’feshe-Woh
AIYA-KATA *(after each line)
O’feshe-Weng
Aiya kata
Aiya Koto
Aiya Kiti
Aiya Kutu

O’feshe-Lu
AIYA-KATA *(after each line)
O’feshe- g’Ba

Oh-----.......

Basket mouth wan start to leak again, oh-
BASKET MOUTH WAN OPEN MOUTH AGAIN, OH
Abi** you don forget I say I sing, ee-oh **(is it not)
BASKET MOUTH WAN OPEN MOUTH AGAIN, OH
Oh, I sing, I say, I go my mouth like basket, ee-oh, Malan Bia-gbe-re
(2x)

Basket mouth wan start to leak again, oh-
BASKET MOUTH WAN OPEN MOUTH AGAIN, OH

Fela, wetin you go sing about?
DEM GO WORRY ME… *(after each line)
(3x)

Dem go worry me, worry me-- worry, worry, worry, worry
DEM GO WORRY ME *(After each line)
Dey wan to make us sing about prison
Dem go worry me, worry me-- worry, worry all over da town
Dey wan to know about prison life
Dem go worry me, worry me-- worry, worry all over da town
*(repeat stanza)

Fela, wetin you go sing about?
DEM GO WORRY ME
Dem go worry me, worry me-- worry, worry, worry, worry

The time weh I dey, for prison, I call am “inside world”
The time weh I dey outside prison, I call am “outside world”
Na craze world, na be outside world

CRAZE** WORLD *(after each line) / **(crazy)
Na be outside- da police-i dey
Na be outside- da soldier dey
Na be outside- da court dem dey
Na be outside- da magistrate dey
Na be outside- da judge dem dey
Na craze world be dat
Na be outside- Buhari dey
Na craze man be dat
Animal in craze-man skin-i
Na craze world be dat
Na be outside- Idia-gbon dey
Na craze man be dat- oh
Animal in craze-man skin-i
Na craze world be dat
Na be outside- dem find me guilty
Na be outside- dem jail me five years
------------------I no do nothing
Na be outside-dem judge dey beg ee-o
Na craze world be dat, Na craze world be dat
Na be outside- dem kill dem students
Soweto, Zaria, and Ife
Na craze world be dat, ee-oh
Na craze world be dat,
Na be outside- all dis dey happen
Na craze world be dat, ee-oh
Na craze world be dat, ee-oh
Na craze world be dat, ee-oh
Na craze world be dat, ee-oh
Na craze world be dat, ee-oh…..


Make you hear this one
War against indiscipline, ee-oh

Na Nigerian government, ee-oh
Dem dey talk ee-oh
“My people are us-e-less, My people are sens-i-less, My people are indiscipline”

Na Nigerian government, ee-oh
Dem dey talk be dat
“My people are us-e-less, My people are sens-i-less, My people are indiscipline”

I never hear dat before- oh
Make Government talk, ee-oh
“My people are us-e-less, My people are sens-i-less, My people are indiscipline”

Na Nigerian government, ee-oh
Dem dey talk be dat
Which kind talk be dat- oh?
Craze talk be dat ee-oh
Na animal talk be dat – oh
Na animal talk be dat – oh

MANY LEADERS AS YOU SEE DEM
NA DIFFERENT DISGUISE DEM DEY-OH
ANIMALS IN HUMAN SKIN
ANIMAL-I PUT-U TIE-OH
ANIMAL-I WEAR AGBADA
ANIMAL-I PUT-U SUIT-U
*(2x- 2nd time with lead voc)

These disguising leaders ee-oh, na wah for dem [sax responses after each]
Dem-o hold meeting everywhere, dem reach America (2x stanza)

Dem call the place, the “United Nations” [sax responses after each]
Hear-oh another animal talk
Wetin united inside “United Nations”?
Who & who unite, for “United Nations”?
No be there Thatcher & Argentina dey
No be there Reagan & Libya dey
Is-i-rael versus Lebanon
Iran-i-oh versus Iraq-i
East West Block versus West Block East
No be there dem dey oh- United Nations
Dis “united” United Nations
One veto vote is equal to 92 […OR MORE, OR MORE]
What kind sense be dat, na animal sense (2x)

MANY LEADERS AS YOU SEE DEM
NA DIFFERENT DISGUISE DEM DEY-OH
ANIMALS IN HUMAN SKIN
ANIMAL-I PUT-U TIE-OH
ANIMAL-I WEAR AGBADA
ANIMAL-I PUT-U SUIT-U
*(2x- 2nd time with lead voc)

Dem go hold meeting, oh, Dem go start yab human beings
Animal talk don start again
Dash dem, human rights

Dem go hold meeting, oh, Dem go start yab human beings
Animal talk don start again
Dash dem human rights
*(repeat stanza)

How animal go know-say dem no born me as slave?
How animal go know say slave trade don pass?
And, dey wan dash us human rights
Animal must talk to human beings
Give dem human rights

I beg-I, oh , make you hear me well-u well
I beg-I, oh, make you hear me very well

Human rights na my property
So therefore, you can’t dash me my property
Human rights na my property
Dey wan dash us human rights

Some people say, “Why I dey talk like dis,
No be talk like dis, dem take to carry me go prision ee-oh”
No be me dey talk, na Prime Minister Botha dey talk, ee-oh (2x)

Him say, “this uprising will bring out the beast in us”
THIS UPRISING WILL BRING OUT THE BEAST IN US
(repeat stanza 3x)

Eh Ji Keke- my argument

Botha na friend to Thatcher & Reagan
Botha na friend to some other leaders too
And together dem wan dash us human rights
Animals wan dash us human rights
Animal can’t dash me human rights
Animal can’t dash us human rights

MANY LEADERS AS YOU SEE DEM
NA DIFFERENT DISGUISE DEM DEY-OH
ANIMALS IN HUMAN SKIN
ANIMAL-I PUT-U TIE-OH
ANIMAL-I WEAR AGBADA
ANIMAL-I PUT-U SUIT-U
*(2x- 2nd time with lead voc)

Beasts of no nation- Egbe Ke Gbe na bad society

BEASTS OF NO NATION, EGBE KE GBE
BEASTS OF NO NATION, OTURU GBE KE
(repeat stanza many x, lead vamp)

Easy… easy

Outras Músicas de Fela Kuti

Conheça aqui outras músicas de Fela Kuti que você poderá gostar.

Baixar Música Beast Of No Nation (Fela Kuti) em MP3

Você pode baixar (fazer o download) ou ouvir diretamente a música Beast Of No Nation de Fela Kuti no seu celular ou computador através do player abaixo.

Ouvir "Beast Of No Nation"
na Amazon Music Unlimited
Ouvir "Beast Of No Nation"
na Amazon Music Unlimited
Baixar Música Agora!

Ficha Técnica da Música Beast Of No Nation

Número de Palavras818
Número de Letras5418
IntérpreteFela Kuti

Na tabela acima você vai encontrar dados técnicos sobre a letra da música Beast Of No Nation de Fela Kuti.

Amazon Music Unlimited